Parents Most Enkorage Dia Shidren To Use Dia Gifts
Mary force Oga Jesus Krist make hin use di cirkumstans to showcase hin mirakle working pawa. She refused to stop ontil Oga Jesus Krist do Hin first mirakle. Di dramatic even hapun fo one marriage ceremony fo Cana of Galilee. Do bible talk say, Wen wine finish, Jesus mama tell Am, “Dea wine don finish.” Jesus ansa am, “Mama, why you dey tell me? My time neva rish.” So En mama kon tell di savants sey, “Anytin wey E tell una, make una do am.” Fo that place, six big wota pot dey and only one fit kontain about twenty to thirty gallon fo wota, wey di Jew pipu dey use wosh leg as dea tradishon talk. Jesus tell di savants, “Make una full di pots with wota.” So dem kon full all di pot with wota. Jesus tell dem, “Make una take some wota from di pot go give di chairman fo di party.” So, dem do as e talk. Wen di chairman taste di wota wey don turn to wine, bikos e nor know how e happen (but di savants wey draw di wota know), e call di man wey dey marry kon tell am sey, “Wen pesin dey do party, na betta wine e dey first serve pipu, den wen di pipu don drink taya, naim e dey serve cheap wine. But you kon keep di good wine until di party don almost finish!” (John 2:3-10).
LESSON
Parents must to dey enkorage dea pikin to dey use di talents wey dem get. Make we learn from Mary who force her son Oga Jesus make he bring out hin talent! At least nobodi know sey Oga Jesus get dat kain pawa ontil di time of wedding fo Cana of Galilee, weh Hin mama shalenge am say make he do sumtin! Before dat time no bodi know Oga Jesus to be somebodi wey special. On di oda hand, Mary don know from home say her pikin get one kain strong pawa. From her daily observason, she don see kon konklude say her son get some kain pawa to perform miraku. So, wen di opportunity kom, she show Hin gift and talents to di whole world to see and benefit. Yes of course, Oga Jesus later talk; He perform Hin first miraku, and di rest na history!
PRAYER
Oga God, let me be a good parent wey go dey enkorage my shidren to bring out dra best behavior. Help me to dey sensitive to recognize di habit wey go benefit dem. Once I don dey aware of dea habit, kon give me grace to properly direct dem, so dat dem go dey successful. I also pray di same prayer fo all parents and dose wey wan be parents. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.