If You Stand Up For God You Will Reap The Reward
Daniel and hin fellow three Hebrew boys (popularly know as Shadrach, Meshach, and Abednego) decide sey make dem no defy deasef with Nebuchadnezzar foods weh violate dea faith and practice. Dem choose to obey God pass to lavish dea stomach with Babylon kind food. Daniel, speak fo hin other two people say to king servant,
“I beg test your servants fo ten days, and make dem give us vegetables to eat and water to drink. Dat time make see our appearance, and oda youngr men appearance weh dey eat di portion of food weh king dey cook; and after you see am you fit, deal with your servants.” So hin agrer with dem in this matter, and test dem ten days” (Daniel 1:12-14).
Since Daniel and hin fellows honore God with dea faith, God blessed dem in return. Di bible talk am,
“As fo these four young men, God give dem knowledge and skill fo all literature and wisdom; and Daniel get understanding fo all vision and dreams. Now fo di end of di days, when di king hear he talk sey make dem bring dem inside, Di chief of di eunuchs bring dem inside fo Nebuchadnezzar. Den di king do interview fo dem, and among dem all nobody dey qualify like Daniel, Hananiah, Mishael, and Azariah; dey serve before di king. And fo all matter of wisdom and understanding about wetin di king examined dem, he found dem ten times better pass all di magicians and astrologers weh dey fo all hin realm” (Daniel 1:17-20).
LESSON:
God honor pipu weh get faith; Him go stand by dem and ensure say dem no put to shame. Fo this time and age, acts of steadfast faith don dey unpopular; however, God dey
seek fo pipu weh go make Am proud in dea decisions. Jehovah is searching fo pipu weh go stand up against opinions weh dey contradictory to Hin will. Pipu weh stand up fo God gol be honore; dem gol dey favore pass dea peers, and dea name go ever dey affixed to God good book! Fo dis reason, children of God must dey close to dea bible. We must search dey search bible to know God true requirements. Our lifestyle must dey consistent with di bible, and we must consider satisfying God our top priority. Yes, our godly decisions fit draw fire from other folks; dem fit attempt to abuse, oppress, and persecute us. Yet, crowns of righteousness go dey wait fo us fo heaven! Di host of heaven go rate us high if we resolute inside our faith, and remain kontrite kristians.
PRAYER:
Dear God, i beg make me to be konfident kristian weh no go settle fo anything pass your requirements. I beg make me to be person with faith, and me have resilient and unshifted bible principle. Let my work and lifestyle meet your standard, so that your name fit dey glorify fo this corrupt and evil world. Make me to be your agent of light inside this world weh full of darkness, and make you let your testimony of victory ever remain inside my mouth. I beg keep me konsistent with you so that i fit dey celebrated fo heaven. Fo in in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.