As A Christian You Are Fortunate
A God pikin must maintain hin konfidence in God, and remain steadfast with hin or her konfession of faith in Jesus Krist. Di bible talk am,
“Because God no give us spirit to fear, but of pawa and of love and of sound mind. Therefore make you no dey ashame of di testimony of our Lord, nor of me Hin prisoner, but share di suffer with me fo di gospel according to God God pawa” (2 Timothy 1:7-8).
LESSON:
Kristians bi di most fortunate pipu fo earth, and dem suppose remain konfident with dea faith konviction in Jesus Krist. Kristians be heavenly bound pipu; Krist go advocate fo dem on God last day of judgment since dem don konfess Jesus Krist as dea personal Lord and Savior. Krist go plead on behalf of Hin followers and ask God to forgive dea sins fo di sake of Hin blood weh E don shed on fo dea behalf. Since Krist dey sinless but die fo sinners, God go honor hin equest and exonerate kristians! Therefore, e dey prestigious fo anyone to be kristian! A pesin weh never turn to Jesus Krist suppose do am - without wasting time - since Krist bi di only formidable advocate weh fit withstand God Judgment. Kongratulations to anyone weh don take di wise decision to confess Jesus Krist as hin or her personal Lord and Savior - fo heavenly home go be hin or her permanent resort!
PRAYER:
"O the Blood of Jesus wash me. O Blood of Jesus shed fo me. What a sacrifice weh save my life. Yes di blood bi my victory"
Thank you Oga Jesus Krist fo di good works weh you just finish on di cross me! You die to save my soul from kondemnation and judgment of hell. Therefore, I yield my komplete life to you today! I declare you Jesus Krist as di Lord of my life, and I konfess you as my personal Savior. I beg wash my sins away, and declare me as your bonafide pikin weh go inherit your everlasting kingdom. Thank you Jesus Krist fo your grace weh dey save. Amen.