To dey speak di truth of God word and to dey live am fo pipu to see
Jesus Krist unlike other teachers of him time, him teach fundamental truth and God principle wey fit cause problem fo di place. Him analyze different controversial topic and him simplify God word fo pipu to get better understanding of wetin God require of holiness. For example, Jesus dey teach pipu, him kon talk say,
1. Make una bless dos wey kos una and (Luke 6:28)
2. Make una give evribodi wey ask una for somtin (Luke 6.30)
3. Make una do fo pipu as una wont make dem do fo una (Luke 6:31)
4. But make una love una enemies (Luke 6:35)
5. Make una nor joj oda pipu (Luke 6:37)
6. Make una give well well to pipu wey nor get (Luke 6:38)
LESSON
Christians must continue to dey follow di principle of Jesus Krist, as dem dey teach pipu all di important thing weh bi di kingdom of God. Some truth fit dey pain person, pipu still go dey hear am make dem fit understand God requirements for him kingdom and make dem they follow am. Another thing be say, we believers must ensure say we dey preach wetin we dey practice and make we dey lead by example to dey motivate pipu into godliness.
The basis to dey speak di truth we dey God kingdom no suppose dey based on person holiness. Whether as a Christian you still dey struggle to dey comply with God law in one area of ur life abi you no dey comply, you still need to speak God truth all di time without dilution. God righteous standard no fit ever change, so, believers need to dey preach am all di time. We must dey learn from Jesus wey bi say him preaching fo di scripture talk about holiness well well - as di only thing wey fit make person enter di kingdom of God, Jesus even talk say… “Bot make una first do di gud tins wey God wont and every oda tin go bi una own” (Matthew 6:33)
To kon add, for Christian to adequately comply wit God righteous standard and kon still preach am, dah pesin go don get Holy Spirit, without Holy Spirit in control, e no dey possible make pesin please God. Na this spirit go encourage us make we love God and our neighbor well. E go even still help us to dey live by example and to dey preach di gospel well.
PRAYER
Dear Jesus Christ, help me to bi honest Christian who go dey live according to wetin di scripture talk and make i dey preach truth of your kingdom. Give me your Holy Spirit to dey live holy and life wey you go accept. Make your divine spirit give me heart wey dey humble “to dey talk di talk and to dey walk di walk” fo di purpose to take benefit your kingdom. When i don finish this earthly race, abeg count me among di pipu wey go enter your kingdom to dey rejoice fo your presence forever! Through your name i ask this things dem. Amen.