Believers Oneness Is Important
Paul pray fo Christians to get spirit of unity so that dem fit serve God together with one mind. Paul pray, “Now make di God of patience and komfort grant you to get di kind good mind to una self, according to krist Jesus, so that una go fit glorify God di papa of our Lord Jesus krist” (Romans 15:5-6). LESSON Christians need to dey operate with unity to promote gospel and expand God kingdom. However, e almost dey impossible to achieve this goal among brethren if Holy Spirit help no dey. Believer need the Holy Spirit pass anything else! Di Holy Spirit go help brethren to dey pursue ultimate goal to satisfy God desires - pass to satisfy world pressure and di craving of flesh. Fo this reason, e dey important say Christian body devote tangible time to seek God face to receive empowerment of Holy Spirit, and operate under hin divine guidance. PRAYER Dear God, I beg baptize Christian community with your Holy Spirit. Make brethren komot self and pride to submit to each dem self with love. Make genuine love reign among brethren, so that your light of gospel fit radiate by dem to di world, and unbeliever go com dey save. Fo na your Son Jesus Christ name i beg fo my requests. Amen.