God Hate Sin
God remind Israelites say punishment to award fo dea sin go dey, unless say dem repent. Di Creator promised to avert evil from hin children if dem change dea mind and pursue righteousness. God talk am, “Sow righteousness fo yourself; make you reap mercy; Break up your fallow ground, na time to seek di Lord, Till him come and rain righteousness to you” (Hosea 10:12). LESSON God punishment to give human sinful actions. Hin righteous standard go grant positive rewards fo people weh pursue righteousness and faithfully serve am. God go pursue and overtake wicked people; he go overpower dem and consume dem with hin judgement. Di Creator desire sey all people repent from dea wickedness so that hin fit bless and award dem with hin immeasurable peace and prosperity. PRAYER Baba God, I know say you don establish standard to prosper people wey dey righteous and surfer people wey wicked. I wan be your righteous pikin so that i go prosper. Abeg empower me so that i go repent from my sin, and make me serve you faithfully so that i go enjoy your blessing here fo earth and fo heaven too. Na Jesus krist name i take make my requests. Amen.