Rewod Dey For Pesin Wey Dey Do Evil
King David dey dey relaxed wit God and he enta problem within a short time. While he sopos be at di war front dey defend hin country, he stay home dey enjoy di komfort of hin palace, but he send him savants go. On di oda hand, Satan see say King David don dey relaxed, so he set him up so he go fall. While in di palace, King David lost hin self-control kon kommit adultery with hin neighbour wife. He also kill di woman hosband to kova hin sin. Di sinful act wey he do spoil David name and dignity. God kon dey embarrassed and he promise to ponish am well-well. Di konsequence of David sin break kamel back! Di sinful moment wey stain David testimoni dey fo di bible, “Before dry sizin, fo di time wey kings dey go war, David send Joab with en ofisas join Israel pipu sojas and dem defeat Ammon pipu kon take-ova Rabbah town. But David stay fo Jerusalem.” One day, David wake-up from sleep fo aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round fo dea, e see one woman wey dey baf fo en house and she fine well-well. So e send messenja go find out who di woman bi. Leta, dem kon tell am sey na Batsheba, wey bi Eliam pikin and na Uriaya wey bi Hit pesin, bi en husband. David send messenjas go call am. Dem call di woman come and David sleep with am. Dat time, di woman just mestrate finish, so e kon go en house back. Afta, di woman kon si sey e get belle, den e send message go tell David. “Di next day, David write leta give Uriaya sey make e give Joab. Wetin dey di leta na, “Put Uriaya fo di front line, where di fight fo strong well-well, so dat dem go kill-am.” (2 Samuel 11:1-5; 14-15). “So Natan tell David, “Na you bi di man and dis na wetin di Oga wey bi Israel pipu God talk. I make you king fo Israel and I safe you from Saul. I give you en wifes and kingdom; I make you king fo Judah and Israel. If dem nor rish fo you, I fo still give you many oda tins. Wetin kon make you disobey my kommand? Why you do dis wiked tin? You kill Uriaya fo war; you allow Ammon sojas kill-am, den you kon take en wife! Naw, fo every generashon, yor shidren-shidren go die anyhow, bikos you nor obey mi kon take Uriaya wife. “I swear sey I go make somebody fo your family bring trobol come give you. You go see am wen I go kollect your wife from you kon gi-am to anoda man and e go sleep with dem fo publik. You sin fo sekret, but I go make dis tin happen fo publik make all Israel pipu see am.” (2 Samuel 12:7-12).
LESSON
Nemesis go catch up wit evil pipu, no mata how far they run! Any pesin wey dey do evil kon bilive say he fit go wit it dey joke! Oga God know he go arrest wiked pipu and ponish dem. No one fit run komot from di presence of God; since He sabi all tins, he go rewod all tins! So, a wiked pesin wey prospa today still fit sofa di konsequence of hin aktions tomorrow. So, all pipu dey shallenged to fear God and dey do tins we good bekos he dey watch us.
PRAYER
Oga God, abeg safe me from sin. I know you dey see all tins, and you go rewod all tins. Now, I ask say make you please give me grace to dey behave as you want fo your presence. No let me dey abuse my opportunity, but help me to dey satisfy you wit holiness evri time. Abeg kon kova me wit di strength of your Holy Spirit so dat I go finish my race well on eart, and end up wit you fo heaven. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.