Expressing Love
King David honored Mephiboseth fo di sake of di konvenant wey he do with hin fada (Jonathan). David and Jonathan be good padi, and dey promise to dey help each oda fo long time. But, Jonathan kon die quick. Before Jonathan die, Jonathan protect David from King Saul attack. Jonathan go against wetin hin fada want wey dey see David as hin rival and want make he die by all means. Jonathan use hin royal rank to protect David and help him to eskape his papa wey won kill am. Howeva, Jonathan and King Saul die fo battle with di Philistines; David kon bekome King. As he get to di throne, David honor di konvenant wey he get with Jonathan and he bring Mephiboseth to his palace kon give am portion of a prince. He also follow di boy talk say, ““Make you nor fear. I go dey kind to you, bikos of Jonatan wey bi your papa. I go give you evritin wey bi Saul, your grand-papa own and anytime wey you come my tabol, I go welkom you.” (2 Samuel 9:7).
LESSON
Love beta pass hatred, and shidren of God must to dey show love to oda pipu. Sometimes, we no fit dey fortunate to experience loving situations evriday of our lives: some situations go won kause make we dey angry or sey make we revenge. Howeva, bilivas must dey love pipu in evri situation. We wey be shidren of God must to dey pursue love and forgiveness. We must to dey pray and dey ask God say make he help us during diffikult situation, so dat we go fit love wen he no dey okay fo us. God go fo sure send hin Holy Spirit to give us pawa to positively respond to shallenging situations in a way wey go glorify him holy name.
PRAYER
Oga God, abeg help me dey respond to hateful situation with godly attitude! Wen cirkumstances dey rough and rash, help me to dey respond positively so di devil go dey ashamed, and your name go dey glorified. Abeg give me pawa through Holy Spirit to remain your good shaid to di end of my life, so dat I go dey qualified to enjoy wit you fo heaven. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
