Our God Dey Undefeatable
Profet Elijah show hin loyalty to God and shame di hypocrite. Di profet shallenged war generals to batu even sey he no get war experience. He rain down fire on di soldiers of King Ahab wey wan arrest am. He dey reported say, “Den di king send one offisa with fifty sojas make dem go arrest Elijah kom. Dem go meet Elijah for where e sidan on-top hill kon tell am, “Profet! Di king sey make yu follow us kom!” Elijah ansa di soja oga, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down, burn all of dem. Di king send anoda offisa and fifty sojas go again. Di offisa tell Elijah sey, “Profet! Di king sey make yu follow us kom.” Den Elijah ansa, “If I really bi profet, make fire kom down from heaven kon burn yu and all yor sojas!” At wons, fire kom down kon burn all of dem.” (2 Kings 1:9-12).
LESSON
God is great, God is strong, and God is powerful; no one can arrest God, and nobody can curtail his power. God is graceful and loving, but his anger is brutal! He could consume the whole world with fire and turn it to ashes within a second. If God stomps his feet in annoyance, the whole world would go disarray and suffer tremendous casualties. Therefore, all people ought to fear God, and pay him due respect. We must pay tribute to God for utilizing his remarkable power to favor humanity. No one else should be due of human praises than God of gods and Lord of lords who resides in heaven and rules over the earth. Moreover, since God remains invisible, people ought to respect his servants that are visible. God’s servants are his ambassadors confirmed with right to exercise authority on his behalf. A person who has respected God’s servant has respected God. Also, a person who has disrespected God’s servants has equally disrespected God. No doubt that anyone who abuses God’s servant will suffer punishments from God.
PRAYER
Oga God, abeg teach me how to dey honor yu and respect yur savants. No let me dey disrespect yu and yur savants, so dat I no go dey ponished. Help me so I go dey treat yur savants well-well kin respect dem join so dat I go receive yur blessin. Abeg let me dey fear yu, and let me dey obey yur kommandment so dat I go prospa in di land of di living. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
