No Be Hearers Only
We Kristen most to dey read and listen to di word of God kon dey apply am to our lives, so dat we go prospa. We most to dey use godly teachings and biblical principles to benefit our lives. Di skripture tok say, “Pesin wey hear God word and e nor dey do wetin e tok, bi like pesin wey dey look en face for mirror. Wen di pesin look ensef finish kon komot go out, e go kwik-kwik forget how en face bi. But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.” (James 1:23-25).
LESSON
Any Kristen wey read and listen to di word of God wey no kon apply am to hin daily life na just like a baby kristen! Oga God want make evri kristen grow and develop well-well. Howeva, Kristen maturity no be on age. We fit get spiritual maturity only by say we dey talb to Oga God. Kristen wey wan grow most to pray and dey stodi di word of God evritym. Also, kristen wey mature most to advance in evangelism. Kristen wey mature most to serve no mata wetin hapun, and dey no dey redi to exchange dia salvason for any eartly enjoyment. Also,he good make we talk am well-well say Oga God no fit do anitin wey dey impotant to Kristen wey never grow finish.He go only do wondas and do great tins thru konfident and mature kristen.
PRAYER
Oga God, abeg let me grow up kin bekom a Kristen wey mature. Help me so I go take Kristenity serious, and help me to dey kommited to it. I wan dey kanpe wit my relationship wit yu, and let me dey please yu in evritin wey I dey do. Also, I wan get mind to dey preach yur gospel and dey represent yu well on eart. Let me serve yu well so I go qualify for yur crown of glory wey no dey perish for heaven. Na for Oga Jesus Krist name I beg all. Amen.
