Respect God’s Anointed
Paul and Barnabas re-oriented their cheerful audience to stop praising mortal men, but praise di living God. Wen Paul preach and perform a miraku fo Lystra, evrivbodi think say he be god, and dey wan offa sakrifice to him. Howeva, di two evangelist tell dem make dem no do so. He dey reported say, “Fo Lystra, dem meet one man wey nor fit waka since wen dem born am. Di man dey listin to Paul as e dey tok. Wen Paul look am fo eye kon see sey e get faith wey go fit heal am, e tell am, “Stand up.” Di man kon jump up and e bigin waka. Wen di pipu see wetin Paul do, dem kon shaut fo Lykaonia language sey, “Awa God don turn to human being kom meet us.” …“Wen Banabas and Paul hear about di tin wey di pipu won do, dem shaut, tear dea klot kon run go meet di pipu sey, “Why una won do dis kind tin? Wi too na human being like una! Wi kon tell una di Good News, wey go make una turn from sin kom meet God, wey make heaven, eart, sea and all di tins wey dey inside dem.” (Acts 14:8-11; 14-15).
LESSON
We must dey respect di savants of God, but we must no woship dem! Pipu must to ondastand di different between “respect” and “woship.” He dey impotant make evribodi know how to dey relate wit Oga God and hin savants and dem no kross di necessary boundary. God na di only idol wey pipu must dey woship; God savant are pipu wey we must to dey respect. Oga God dey sensitive and na Hin get Hin glory; He no go share am wit anybodi (Isaiah 42:8). On di oda hand, di savant of God karry divine pawa; dey don dey provided wit pawa to preach di gospel and use authority in oda to direct pipu attention to oga God.
PRAYER
Oga God, abeg help me to dey sensitive so I no go give your glory to ordinary man or woman. Let me dey offa you di glory and honor wey you sopos get evritym. To add to am, kon give me grace to dey respect your savants so dat I go get your blessins. Help me to dey pray and offa help to for your savants, so dat dem go dey motivated to serve you more. Abeg bless me also as I dey try obey wetin you talk. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
