Our God Dey Full Of Wonders
Oga God do many mirakus thru Profet Elisha wen he still dey alive. Na thru him dead body kom back to life, metal axe dey flow on top wota, and a time wey tay well-well wey food no dey end before di next day. But, di greatest testimoni wey Elisha get neva dey mentioned! Hin dead bone wake pesin wey don die! Di skripture talk am as it take hapun, “So Elisha die and dem kon beri am. But as anoda year dey start, Moab pipol kon attack di land. One day, some men dey beri pesin wen dem si some pipol dey kom attack dem. So dem kon trow di dead body inside Elisha grave. As di dead body tosh Elisha bone, di man wey don die kon wake-up.” (2 Kings 13:20-21).
LESSON
Oga God dey full of wondas and he go do great tins for hin shidren. Oga God go bless hin shidren and he go use dem bless oda pipu join. Pesin wey serve God well-well kon obey wetin he talk join go get a basket wey dey full of testimoni. Notin go stop di pesin make he get success! So, all pipu most to ondastand sat to serve Oga God get gain wey plenti. Any pesin wey get korage to stay kanpe wit Oga God no go regret am – no mata wetin hapun!
PRAYER
Oga God, I don know say yu go do great wondas for any pesin wey serve yu well-well kin obey wetin yi talk join. Now, I wan dey obey yu and kin dey kanpe wit yu. Abeg help me to dey stop all form of ungodliness so I go fit enjoy yu well-well. Let me dey love and serve yu well-well, and lete dey qualify to receive yur blessin wey no dey shake for dis eart and for heaven.Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
