Believers Are Commanded To Love
Kristenity na all about love. Shidren of Oga God most love, care, pray, minista to each oda – evri time. Any physical or spiritual service wey kristen offa wen love no dey no be konfam, and God no go rewod am. Di skripture tok am di importans of love wen he say, “If anybody among una nor well, make e koll di eldas for di church, make dem pray and use oil anoint am for Jesus name. Di prayer wey dem take faith pray go save di pesin wey nor well and God go make am well. And if e kommit any sin, God go forgi-am. So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.” (James 5:14-16).
LESSON
Love dey pawaful and dey impotant for all kristens. Brodas and Sistas most to dey show true love to diasef. Brodas most to dey kare without mago-mago! We most to dey kare for each oda witout say we dey separate pesin or dey partial. Howeva, for Krist love to to reign in di kristen fold, we most to dey show forgiveness, dey pray for each oda, and pray togeda as a team. Also, we most dey humble to konfes our sin to one anoda, and we most make konfam efot to bring back our brodas wey don fall from faith. To talk am well-well, love go tie brodad togeda, and go give Holy Spirit free hands to walk many mirakus wit us.
PRAYER
Oga Jesus Krist, abeg help bilivas to dey walk in love. Let to dey love and kare for each oda well-well. Let brodas dey minista to each oda in prayers and enkoragement. Let brodas dey provide for each oda in food, cloths, money, and oda tins wey dey impotant. Help us to dey visit our brodad for hospital; let us to dey offa moral sopot for pipu wey dey in nid. Let yur love wey be konfam dey real in di kristen fold so dat yur glori go fit spread in our lives wit signs and wondas. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
