Oga Jesus na di Only Way Of Salvason
Abraham, Isaac, Jacob, David, and Oga Jesus Krist be good bible karacters; but na Oga Jesus Krist dey okay pass for di list. All di bible karacters die and dia body sofa, except Oga Jesus Krist! He die and he wake up on di third day witout say hin body sofa. Di skripture konfam am say, “Bikos David, afta e don do wetin God send am kon do among en pipol, e kon die and dem beri am with en grand-grand papa dem and e rotin, but di pesin wey God raiz-up, nor rotin. So my pipol, make una know sey, na thru dis Pesin wi dey prish sey, ‘God go forgive una.’ True am, evribody wey bilive, go dey free from evritin wey Moses Law nor fit free dem from.” (Acts 13:36-39).
LESSON
Jesus Christ is the Son of God that was sent to save the world from their sins. He died for the sake of our sins, and resurrected to earn us the gift of eternal life. All pipu most to konsida say Krist go wake up as di main reason why dem most serve him. Oda idols (wey be good and bad pipu wey don die) witout say dem dem wake up immediately. Muhammad and Buddha no wake up afta dia death oda great bible karacters sef no wake up afta dia death Also, all preachers wey don pass and great ledas die witout say dem wake up. Na only Oga Jesus Krist wake up from di dead. Di bible talk say anybodi wey bilive in Oga Jesus Krist as di Son of Oga God kin konfes him as hin personal Lord and Savior go dey saved (Romans 10:9-10). Di pesin fit die for small time, make hin body sofa, but di pesin go wake up on di last day to enjoy life wot God wey no dey finish for heaven. Since death no fit hold Oga Jesus Krist to di grave, anybodi wey bilive jim go wake up on di last day to dey receive di gift of life wey no dey finish. Krist bilivas go receive krown wey no fit perish from God for heaven, and dem go get joy and peace wit God.
PRAYER
Oga Jesus Krist, I don know say yu don sofa and die so yu save and give me di gift of life wey no dey finish. Wat a wondaful and loving friend yu be! I love yu very mush. I don talk say I go dey serve yu faithfully from today. I konfes say yu be di Son of God; yu be my Lord, yu be my Savior, and my King. I go faithfully folow and serve yu for di rest of my life. I give yu all my praise wey kom from my heart, and I say thank yu say yu save my soul! Amen.
