Oga Jesus’ Pattern For Saving Di World
Oga Jesus show Hin status as Krist – du Messiah of di world. He also show his wetin he wan do to wake up from death and save di world. Oga Jesus tok say, “But as for Mi, if una karry mi go up fo cross, I go draw evribody kom meet Mi.” (John 12:32).
LESSON
Oga Jesus be Krist, and he be Lord. He don form di pattern through which He go safe di world. Krist master plan na to die, kon wake up from di dead so he go fit safe di world. He do all tins akordin to plan. He endured all punishment of Hin enemis, he die on di kross; dem bury am, he kon wake bak to life on di third day! Afta he don wake, he do meeting wit hin pikin wey dey folow am and he tell dem say he go wake up afta they die. Di savior also promise say he go apply di same tin to anyone wey believe am. All pipu wey belive in Oga Jesus Christ go wake up from dead to life, and dem go take dem to heaven on di last day. On di oda hand, Oga Jesus Krist no promise to wake di unbelivas to heaven. Sadly, unbelivas go get dea space fo hell fire - wea dem go dey punish dem fo life! So any pesin wey wan go heaven kon accept Oga Jesus Krist as Lord.
PRAYER
Oga Jesus krist, I go stop wasting my time by living in unbelief! I no wan dey play wit hell fire again; therefore, I konfes my sin and I repent from dem. I also konfes you Oga Jesus Krist as my personal Lord and savior, and I belive say you don die fo my sins and you don wake up to give me life wey no dey finish. Since I don become your shaid, I dey sure say you go wake me up from death to life, and I go enta heaven. I don dey heavenly bound! Yes, I dey go heaven; shame to do di devil and glory to God! Amen.
