Surrender Yur Life To Oga Jesus
David tok am di benefit wey he don kolet from God since di time wey he don give hin life to him. Di man David tok say, “I wait with patient make God kon help mi, and E turn kon hear my kry. E take mi komot from di pit where shame, pain and sofa full kon put my leg for groun wey strong well-well, den E make mi strong as I dey waka. E don give mi new song to sing and hymns wey I go take praiz awa Oga God. Many pipu go si wetin E do kon praiz am, den dem go start to trust God. Make una si as pipu wey trust God dey happy; Doz wey nor like proud pipu or woship juju.” (Psalm 40:1-4).
LESSON
Any pesin wey give hin life to God go kolet Hin benefits. Di felow go receive di help of God anitym he need am and go dey blessed. Howeva, pesin fit nid to apply some extra effot to trust God wen tins no dey go well, Since tins wey no good dey come wit pressure. Any pesin wey get kourage to trust God and make Hin dey involved in his/her challenges go soon laugh. God dey care fo hin shidren, and he ni go allow any situation or condition put dem to shame. Jehovah go defend Hin pipu wey trust am, and He go see say dey sing songs of testimony.
PRAYER
God abeg, Kon teach me how I go trust you wen tins no dey go well. Help me to dey call on you fo help during trials, so I go dey hapi to testify to your goodness fo all di days of my life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
