A Fool Tok Say God No Dey
Di bible clearly tok say pipu wey say God no dey be fool. If God no dey, who kon do all di beautiful tins wey we dey see today? If God no dey, who go kon kip di climate, weather, and season di way dem dey so? If God no dey, who kon make human beings as dem fine so as we dey see dem today? God dey real, and Hin supremacy go last fo life wey no dey finish! Di bible worn pipu wey dey tok say God no dey make dem dey repent. Di bible tok say, “Na fools dey tok fo dea heart sey, “God nor dey.” Dem don spoil; na bad tins dem dey do and e nor get any one among dem wey dey do good! God dey from heaven look evribody; E dey look to si if anybody really get sense and weda anybody really dey find am. But nor bi so. Evribody don dey sin; evribody don spoil finish. E nor get anybody wey dey do good at-all!.” (Psalm 53:1-3). Di bible tok am again say, “But una sturbones and strong heart nor let una turn from sin kom meet God, so una dey make una ponishment many more-more, fo di Day wen God go judge di world, bikos En na judge wey nor dey support bad tins. God go pay evry man akordin to wetin e do.” (Romans 2:5-6).
LESSON
Pipu wey belive say God dey, dem dey wise, but pipol wey tok say God no dey dem no dey wise. Di bible call any pesin wey tok say God no dey fool! (Psalm 53:1-3). God dey real and no bodi fit tok say He no dey exist. Even say we no see am wit our koro-koro eyes, but we dey see Hin works. Unlike common argument say all tins dey by nature, God kreate all tins. In fact, God kreate di nature Hinsef. Nature no produce human beings wey dey fine wey we dey see. God make human beings kon do dem well-well. Man get two ears wey dey fo di head; man get two legs wey go dey make am stand well, man get two eyes wit lashes wey go dey pursue insect and flies. Man get mouth to eat food and get yansh to shit di food wey he don chop. Who tok say God no dey? Dat pesin no dey wise! Who kon form di sky di way di way di color and shape dey? Who kon make di trees make dem dey grow green leaves and he no dey spoil pesin eyes? Who dey make di sun rise and make di sun set and dey neva miss di tym wey dem go come out and go in? Who con make di climate and weather to dey repeat dea yearly and seasonal schedules and dem no go fail? In fact, science sef no ondastand say sumtin dey significant behind di kreation. Na one diety kreate all tins, and dat diety na God – and all pipol mist to hallow Him! On di oda hand, di beauty of dis world be notin to di beauty of heaven wey God dey prepare fo Hin saints. So, any any pesin wey wan enjoy di beta woks of God must to dey desire to go to heaven. Oga Jesus Krist na di only son of God and na only through hum weh fit enta heaven. All pipu must to belive am.
PRAYER
Oga God, I ondastand say hey dey foolish to argue say you no dey. I know sey you dey exist and I know sey u dey real more dan anitin! I thank you fo di beautiful eart wey you kreate. On di oda hand, I ondastand say you get plenti woks to show fo heaven, and I wan see dem also. Abeg, count me worthy to enta heaven in di last day. I belive your Son Oga Jesus Krist, and I accept am as my personal Lord and savior. I know sey I go dey accepted fo my kindom through my faith in your Son Oga Jesus Krist. Amen.
