Heart Wey Dey Humble
Oga Jesus Krist wash di feet of hin pikin wey dey folow am to show humility, and he tell dem say make do di same to odas. Krist tok say, “Una dey koll mi ‘Tisha’ and ‘Oga God’, una korrect, bikos na so I bi. So, if mi wey bi una oga and tisha, wosh una leg, e good make una wosh each oda leg too. I don give una ezample wey una go follow. So make una do fo each oda as I don do fo una.” (John 13:13-15).
LESSON
Belivas wey dey in Oga Jesus Krist suppose to dey humble and serve oda pipu. No be say make we serve God faithfully only, but make we dey provide fo di nids of oda pipu. Kristens must to dey kip dea felow belivas. He dey important make God saint dey wok in untiy, and make we ondastand say, “wateva incident wey to one beliva don happen to all belivas!”. No kristen must to dey use hin pawa or nids anyhow and think say odas no dey lower to am. While evribodi no be leaders, We all dey to serve – and we must to serve each oda without mago-mago. Evribodi must honor di true symbol of Kristenity – which be love!
PRAYER
Oga Jesus Krist, I receive your grace by faith to love oda pipu without mago-mago. Help me to dey sopot my felow kristens and make I dey make beta kontribuson to dea lives. Kon let my interest in pipu success be konfam. Abeg, make your love dey inside my heart richly from now and always. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
