Oga God Is Great And Greatly To Be Praised
All pipol most to dey praise Oga God; make we learn from a psalmist wey talk say,
“My soul, make Yu praiz God! My Oga God, si as Yu dey great! Yor glory dey shine well-well kon kover evriwhere. Yor dress dey shine like lite And Yu stresh di sky like curtain for heaven; Yu build yor palis kon put am on-top di kloud where rain from dey kom.Yu turn di kloud to yor shariot kon dey ride am on-top di wind. Breeze na yor messenja and fire na yor savant.” (Psalm104:1-4).
Lesson:
Di wisdom of God wey we no fit talk pass human thinking, and he dey diffikult to talk. In fact, di pawa of Oga God pass wetin any scholar fit talk. He dey necessary for all pipol to praise di name of God for all his goodness.
Prayer:
I praise you Oga God for you dey so good to di pipol wey you don kreate. Your goodness to pipol no get plenti well-well so I appreciate you. I ask say make you kontinue to teash my heart to know your goodness, so dat I go fit praise you di more. Ma for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
