Oga God Go Rewod You Fully For Your Service
Children of God dey shallenged to avoid idol worship. No one is dey allowed to carve an image to represent Oga God, and no one most to worship image wey dem carve. Di skripture talk am say,
“So, as e bi sey wi bi God pikin, make wi nor tink sey God bi like image wey human being use gold, silva or stone take make. God don forgive us for di time wen wi nor know wetin wi dey do, but naw, E dey kommand pipol for evriwhere sey make dem turn from sin kom meet am, bikos E don choose one day wey E go take judge di world with raitiousness thru di man wey E choose and show evribody wen E raiz am from dead” (Acts 17:29-31).
Lesson:
Everyone on eart most to serve God and relate wit him thru faith in Oga Jesus Krist. We dey warned not to serve any image wey dem carve in place of God! On di oda hand, he no make sense for anyone to try represent Oga God wit an image wey man build! Oga God forbid any image wey dem carve wey dem use represent am. It is written, “Make una nor do any image like wetin dey heaven, eart or inside wota.” (Exodus 20:4). Howeva, a true worship to di living God most to be done in di (Holy) Spirit witout di use of physical body ; just as he dey written, “But di time dey kom and e don even rish, wen di pipol wey won really serve God, go serve am for di true way, wey God Spirit go show dem. God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem” (John 4:23-24).
Prayer:
Oga God, I know say you dey real and you dey alive foreva; so, I don redi to serve with faith witout say I want anitin. Help me to avoid anitin wey go represent idol worship. Give me pawa thru your Holy Spirit to serve you truthfully, and to serve you how you want am. Give me grace to dey loyal to you from today and foreva! Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
