Oga God Dey Above All
Na konfam talk to say, “Na God bi king! Make di nashons shake with fear!” (Psalm 99:1).
Lesson:
Oga God na di highest of all beings wey dey dis eart. Evritin wey dey dey for heaven and di eart most obey hin pawa. Oga God kreate all tins: he design kon produce dem witout say he ask any pesin. So, all pipol most to dey shake onda his pawa wey big, and we most to dey praise hin name. Let all soul wey dey live shout “Hallelujah Oga God reigns!”
PRAYER:
I ask you Oga God say make you please give me grace and ability to praise you from di bottom of my heart. Let me dey praise yoy ontil I breathe my last breathe for dis eart. Let di testimoni of your goodness foll my mouth foreva. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
