We Nid Faith Wey No Dey Shake To Walk Wit God
Berea Christians accurately proved di true meaning of Christianity, and they set good examples for oda pipol to follow. Di skripture tok say,
“Dis Jew pipol get betta mind pass di ones wey dey for Tesalonika, bikos dem open mind take bilive di message and dem dey read God word evriday to shek weda all di tins wey dem hear, na true. 12 Na so many of dem take bilive, even with some big-big men and wimen wey bi Greek. (Acts 17:11-12).”
LESSON:
We fit show true Christianity in action dan in word. Bilivas most dey show dia ondastanding of di skripture thru dia konsistent relationship wit Oga God, and by showing love to odas. Any pesin wey go be called christian wey dey devot most to dey search di skriptures and apply lesson wey he learn to hin life evriday. He dey impotant make Christian show wateva teashing wey he/she dey receive kin use am wit di bible. Any teashing or knowledge wey no get root in di skripture most to dey rejected; konfam talk wey dey seen in di bible most to dey celebrated! Evri shaid of Oga God don dey komisoned to serve God in Spirit and in truth. (John 4:24).
PRAYER:
Oga God, I wan be a devout Christian wey dey stodi your word daily, kon dey apply evri necessary lesson to my life. Abeg help me to ondastand di principles of di bible; help me to to dey obey your laws, and help me to maintain konsistent relationship wit you. Help me to be a Christian wey dey honest, and bless me for evri good efot wey I make to satisfy you. Give me grace to remain a devout christian all di days of my life. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
