Hold Fast Di Word Of God
Paul talk am di importans of di word of God (both in Logos and Rhema background). He talk say,
“Nor bi only thru ordinary word wi take prish di gospel give una, but na with di Holy Spirit pawa and wi show sey, evritin wey e tok, na true. Una know how wi dey live and help una.” (1 Thess. 1:5).
Lesson:
Di word of God dey serves two impotant porpos: hw dey give insightful knowledge (which dey known as logos) and spiritual pawa (which is known as rhema). Both impartasons dey impotant for anyone wey wan prospa on eart, and also to enta into di kindom of God. Since di word of God dey impotant, evri Christian most to dey read am. Di more a Christian stodi di word of God, di more beta hin life go bekom.
Prayer:
Oga God, abeg help me to dey stodi di bible (wey be your word) evritime. Give me your grace to dey konsistent wit your word so dat I go gain knowledge and wisdom nided to live a a successful life on eart, and also to dey counted worthy to enta your for life kindom. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
