Oga God Hates Wikedness
Oga God hates wickedness, and he dey tell wicked pipu make dem repent from dea evil ways. Jehovah go bless dose wey repent, but di end game go dey rough, difficult fo di wicked pipu. God talk say, “E go bad fo dose wey nor dey sleep fo nite, bicause of di bad things wey dem dey think and plan to do. Fo early morning, dem go rush go do wetin dem plan,
Bikos dem get pawa to do am. Wen dem wont pesin land, dem go dey find how dem go take seize am and wen dem wont pesin house too, Dem dey take am by force. Dem dey opress, cheat and take pipu property.” (Micah 2:1-2).
LESSON
Oga God no dey walk di same way di wicked pipu dey walk. He hates wickedness! Pipu wey dey soffer others, dey abuse dea positions no go get di mercy of di judgement of God only if say dey repent. As say we dey talk about wickedness, repentance must be di only option. Since Jehovah know all things and dey see all things, He go make Hin righteous judgement kom on di wicked pipu soon. Howeva, some good action wey God want – wey go bring blessing – be fairness, justice, compasion. Anybody wey dey find di blessing of God must care fo odas and dey treat dem with respect. Also, di fellow must dey kanpe with God.
PRAYER
Oga God, abeg help me to dey treat other pipu with fairness and respect. No let me dey full of pawa or position wey I fit get, but help me be pesin wey dey in support of good things. Abeg forgive me of my sin wey i don sin before, kon give am back to me your love. Kon give me pawa to dey get pity and dey show your grace on odas so that your name go dey glorified fo every situation. Na fo oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.