We Must Preach The Gospel
Prophet of God tell Paul say make he no take hin evangelistic campaign to Jerusalem. Dey warn am say dem fit persecute kon kill am dea. However, Paul talk say he go go even say dem don warn am “But Paul answer, “Wetin una dey do so, una dey cry dey won break my heart? I ready, nor be only make dem tie mi, but to die fo Jerusalem, bikos of Jesus Krist name.” Because we nor fit stop am again, we kon keep quiet and only en kon sey, “Wetin God want make E happen, go happen.”(Acts 21:13-14).
LESSON
God dey find dedicated preachers wey go put preaching of di gospel over any oda thing. Servants of God – wey get different talents and abilities – must to get courage to komot fo dea comfort zone kon preach di gospel. God don give grace to di lives of men and women wey fit preach start di end time crusade. He dey compulsory say make we use our available resources to raise di name of Oga Jesus Krist. We must use tools wey no be ordinary one to preach di gospel. We must dey sure say pesin wey dey Africa hear di gospel. Na our duty to dey sure say pesin wey dey Asia become born-again. Pipu wey dey South America, ensure sey pesin in Africa hear gospel, North America, Europe, and Australia must to give dea lives to Oga Jesus Krist. Make we servant of God no dey keep quiet, we must dey tell oda pipu make dem accept Oga Jesus Krist as dea Lord and savior so dem go fit enter di kingdom of God.
PRAYER
Oga God I won be fearless christian wey dey preach di gospel everytime, I go do this as much as I get your grace. Help me to dey use di abilities wey I still get fo your sake, kon give me new one join! Help me to dey use di skill wey I get like drama presentation, music, communication, technology and odas to bring pipu to your kindgom. At di end of everything, let me enter heaven and hear your word “Weldone my good servant!” Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.