Di Believer Virtue
A lady wey dem dey call Phoebe get Paul special attention with di exceptional servant heart wey she show. Paul see her effort as she care fo pipu needs. Paul talk am in his letter, “I get better things to talk about awa sister, Foebe, wey be leader fo di church wey dey Cenchrea. Make una welcome am with God name as God children suppose do. And make una give am anything wey e need; bikos she don help mi and other pipu before.” (Romans 16:1-2).
LESSON
Christians effort no dey limited to Sunday worship service, We must to dey show Krist love inside and outside di church. He dey impotant sey we ministers must to dey help others and meet dea needs. Some christian dey in need if wetin we fit do. Some no need extra materials, but need moral support. Every believer must dey sensitive to di needs of others and make significant efforts to help dem. Even if money or material thing dey needed or not , brodas must to dey work as team and dey share common love as Krist go dey expect dem. No broda or sister in Krist must to dey unattended to. Each christian na member of di kingdom of God; they must treat everyone with respect, because we all dey enjoy di benefit of God. However, di fact say God dey watch our attitude wey we dey do to other brodas suppose dey ring in our heart! Whatever we do to a broda or sister in Krist na wetin we dey do to God Hinsef God dey watch us!
PRAYER
Oga God, abeg help me to be Kristen wey dey useful, wey dey offa support and make good contribution to other broda lives. Abeg help me to dey relevant fo your kingdom! Again, I won dey faithful to serve you and support others. Give me resources wey I go use take care of my brodas and sisters in Krist. Kon give me pawa to stand gidigba and support your gospel, and everything wey dey related to it. Give me understanding and energy to do anything wey dey necessary to promote your name in di lives of others, so your name go fit dey glorified always. At di end of it all, make me qualify to hear “Weldone and welcome my good servant in heaven!” Na for oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.