Kristens Are Called To Represent God
Paul win hin opponents with sense by talking on di bible to support hin arguments. Two organized jewish sect (Pharisees and Sadducees) wey join togeda to persekute him for hin ministeral activities become confused wen Paul argue say dey just dey harass him based on di mata wey some of dem believe. (Pharisees believ in resurreson but Sadducees no believe). Paul – wey be lawyer kon turn preacher – show hin skills as di bible talk, “Den wen Paul know sey some pipu wey dey dea na Sadusi and odas na Farisees, e kon shout make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born me. Dem dey judge me today, because I put hope sey pipu wey don die go wake again!” Wen e talk dis thing, kworel kon start between di Farisee and di Sadusi pipu and di kansol kon divide. (Bikos Sadusi pipu believe sey pipu wey don die, nor go wake again and dem nor believe sey anything like angel or spirit dey sef, but Farisee pipu believe all dis tins.) So kworel kon start between dem and some oga fo di law matter wey be Farisee pipu kon stand up dey oppoz di Sadusi pipu sey, “Wi nor see any bad thing wey this man do. Una know weda na spirit or angel talk to am?” (Acts 23:6-9).
LESSON
Christians no dey naïve, but be intelligent pipu wey dey show di glory of God. Believers get natural abilities and inbuilt skills to preach gospel wherever dem go. Our skills must show to motivate oda pipu to be in touch with God. Di creator don raise and train us unda different condition. He don skata us into various disciplines to develop skills and strength needed to spread di gospel. Every christian get one ability or di oda needed to help di gospel help pipu enter di kingdom of God! No, no christian must complain say dem no get resources needed to preach di gospel. Christian of every profession dey expected to bring out dea best fo God. Pipu of special skills must preach di gospel - whether na lawyer, doctor, engineer, architect, nurse, pharmacist, journalist, carpenter, mechanic, accountant, housekeeper, janitor, cashier, clerk, secretary, politician, and odas. All pipu must rise up say dem won preach di gospel of Oga Jesus Krist. Without keeping back, we must preach di gospel to pipu with various culture and backgrounds. If we obey God, devil kingdom go sofa losses and plenti pipu go plenti fo di kindom of God.
PRAYER
Oga God, abeg I won be useful vessel fo you. Kon give me strength to dey use my natural abiliti (my gifts and my talents) to dey preach your gospel. Abeg use me to lead many pipu to your kingdom. I also pray fo my fellow believers wey dey around di world say make you grant dem di courage to keep preaching your gospel. Let brodas keep preaching about you so dat pipu go escape punishment of hell and go dey qualified fo heaven. Let devil dey ashamed and make glory be to your name through our effective evangelism! Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
