Forsake Di Past
King Manasseh of Judah no care about God, but he focus on serving idols. He promote make pipu dey serve idols well-well. He sacrifice hin own pikin to idol (as human sacrifice). He also sponsor oda evil practice wey be witchcraft, sorcery, and spiritism. Di bible talk am about King Mannasseh:”Fo di two courtyard fo God Temple, e build altars for all di stars for di sky. E sakrifice en sons fo fire fo Ben-Hinnom Valley kon dey do juju and many bad-bad tins. E dig one pit and fo dea, dose wey don die, dem dey call dea spirit come back to life. E put majishan make dem dey supavise am. E do many wicked and bad things wey make God vex. Di juju image wey e make, e put am fo God Temple, di place wey God tell David and Solomon En pikin sey, “Dis temple fo Jerusalem, na-im I don choose among Israel land, as my house forever. I nor go make Israel pipu leave di land wey I give dea grand-grand papa again, as long as dem dey obey di command, laws and rules wey I give dem through Moses, my servant.” But Manasseh deceive Judah pipu and dose wey dey stay fo Jerusalem make dem fo sin pass di nashons wey God distroy komot dea, fo dem.” (2 Chronicles 33:5-9). Oga God punish King Manasseh fo di evil wey he do: Invedas capture him kon carry him to Babylon as a prisoner of war. However, di King later repent, and Oga God forgive am of hin sins. He dey reported say, “ Invaders capture and transport am to Babylon as prisoner weh war catch. However, the king later repent, and God forgive am of hin sins e dey reported, “Wen e pray to God, God hear and answer en cry fo help.” (2 Chronicles 33:12). God bring Manasseh back kon give am anoda chance to do damage control.
LESSON
God go forgive our sins if we repent from dem. No sin dey too big fo Am to forgive. Once say we don show true humility and repentance wey be confirm, He go forgive us. On di oda hand, di creator dey expect say make we improve afta repentance. He want say make we leave our old and sinful ways. He want us make we work in a path wey dey fit fo hin kingdom. Di bible talk say, “So, if any man dey inside Krist, e don dey new, Krist don clean di bad things wey e do before and everything don turn to new one!” (2 Corinthians 5:17).
PRAYER
Oga Jesus Krist, you don do enough job to safe my life. You sacrifice your life kon die fo my sins on di cross. I repent from my sins today. I confess dem and leave dem. I accept you Oga Jesus Krist as my personal Lord and Savior. From now on, I don talk say I go start dey work newly with you – and I leave my old way of life. My total life is committed to you from today, and forever! Amen.
