Honoring God’s Savants
Anti gospel pipu plan to kill Paul so dem go fit silence hin campaign, but God stopped dea effort. Di scripture talk say, “Di commanding officer hold di boy fo hand go one korna kon ask am, “Wetin you won tell me?” Di boy answer, “Jew pipu dey plan sey dem go ask you make you bring Paul kom di kansol tomorrow, like sey dem won ask am question again. So make you nor allow dem deceive you, bikos dem pass forty wey hide fo bush one kill-am. Dem don swear sey dem nor go chop or drink anything, until dem don kill Paul. Naw, dem dey wait for you to gri fo wetin dem won ask you.” So di commanding officer tell di boy make e dey go kon warn am sey, “Nor tell anybody sey you don report dis matter give mi.” (Acts 23:19-22).
LESSON
Pipu wey dey attack God savant bekos say dem won stop di gospel expansion just dey waste dea time. Gospel of Oga Jesus Krist no fit dey stop, since En di Spirit of God lead am. On di oda hand, dose we persekute di savant of God dey hurt God, and dem go pay fo dea mistakes only if dey repent. Instead make wey dey hurt di savants of God, we fit choose to dey encourage dem in dea good works. We fit pray fo di servant of God and offa dem anything wey dem need to continue to dey promote God interest fo this world. God divine blessing go reign in our lives as we dey honor hin ministers.
PRAYER
Oga God, I understand say your servants deserve honor ,and I won start to dey honor dem. Abeg forgive me of any way wey no good wey I don handle your servants in di past. Help me to start dey do things well. I go start to pray fo your servants and offa dem help anytime wey dey need am, so dem go fit continue to promote your interest in any capacity wey you put dem. Abeg give me a loyal heart to dey support your gospel, so dat your good works go dey promoted fo pipu live locally and globally and fo your kingdom to get plenti pipu. Na fo Oga Jesus krist name I beg all dis is. Amen.
