God Go Defend Hin Name
Christians dey required to give honor to God, we must not take him fo granted, but we must do anything to make Him happy with our faithful living. Di creator keep Hin big punishment fo any pikin wey fall from di truth. He dey written say, “reserves measurable punishments fo any of Hin children weh deviates from di truth.” E dey written, “Oga God dey jealous well-well; E dey punish dose wey dey oppoz Am and E dey fight against En enemies! Oga God nor dey kwik vex, but en pawa dey great. E must punish wicked pipu. E dey show En great pawa through strong breeze and heavy rain. Na di cloud be di dust wey dey under En leg. God command di river and E kon dry wons; E make all di river dry reach ground. E distroy Bashan and Karmel land and all di trees fo Lebanon, dry finish. Fo God present, mountains dey shake and hills dey melt trowey. Wons God appear, di eart go shake and everybody fo di world, go fear. Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive En vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire And mountains dey skata to pieces fo en presence. Oga God dey good, E dey protect En pipu wen dem dey troublel and E dey care fo dose wey trust Am. But E go use heavy rain take distroy En enemies finish kon push dem enter darkness.” (Nahum 1:2-8).
LESSON
God goodness always dey available to overflow Hin pikin. He fit do anything to defend Hin name in dea lives. However, di bible warn us to dey careful on how we dey deal with God. We no dey allowed to use Hin benefit anyhow; We must to make every effort to dey appreciate Am with living things wey dey godly. If we do things right kon serve him well, di creator go increase Hin goodness in our lives and He go decorate us with more honor.
PRAYER
Oga God, abeg give me grace to walk in your ways everytime. No let me dey take your benefits fo granted, but help me to dey appreciate dem. Give me pawa to dey life wey dey acceptable before you, abeg kon multiply your benefits fo my life, so dat I go fit share di testimoni of your goodness everyday of my life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
