Holy Spirit; The Power weh dey For Acceptable Service
Children of God must see say dem avoid canal approach for spiritual matters.
“Di natural man no dey receive di things of di Spirit of God, for dem dey foolishness to am; nor to talk say e go sabi dem, because dem be spiritually discerned. But he who is spiritual judges all things, yet he himself no rightly judged by no one” (1 Cor. 2:14-15).
LESSON:
Di Holy Spirit no fit operate where carnality reigns. Also, he no fit dey effective for di lives of people who get shallow minds. For Holy Spirit to duly carryout him goodly mission for our lives, we must dey spiritually sensitive and be willing to diligently serve God. Moreover, no Christian fit successfully live holy
life and enjoy God’s benefits without di Holy Spirit. Therefore, E dey essential say all Christians pursue Holy Spirit and allow am to live for di center of our hearts.
PRAYER:
God abeg make me a spiritual person so that I go fit effectively serve you. Abeg silence all works of flesh in my life so that I go fit enjoy all your benefits. For in the name of Jesus krist na him I make my requests. Amen.