God Wey Nobi Our Wey
Saul dey committed to hin family and he dey busy searching fo hin papa missing horse, but God get bigger plan fo arm. God instruct Prophet Samuel make e anoint Saul and ordain arm as di first king of Israel. Di remarkable mata unfolded like dis: “...Now di Lord don tell Samuel fo hin ear di day before Saul kom, saying, “Tomorrow about dis time i go send you one man from di land of Benjamin, and you go anoint arm commander ontop my pipu Israel, dat he igo safe my pipu from di hand of the Philistines; bikos i don look upon my pipu, bikos dea kry don come to mi.” So wen Samuel see Saul, di Lord say tel arm, “Na hin bi dis, di man weh i talk to you about. This one go reign ontop my pipu.” “Den Samuel take flask of oil and put am ontop hin head, and kiss arm and say: “Na bikos God don anoint you commander ontop hin inheritance?” (1 Samuel 9:15-17; 1 Samuel 10:1).
LESSON
God way nobi our way,he fit decide to soprise us in a wey we no fit think of. No pesin fit put God fo inside box, and we no fit talk say na wetin he fit do bi dis by wetin we dey think . God go do anything he talk say e go do and nothing fit change hin plan. On di oda hand, God mind to hin pikin na good one. He talk am say"Bikos i know wetin i plan fo una; my plan na to make una prosper, nor bi to give una wahala and na to give una di kind future wey una dey hope to get." (Jeremiah 29:11). Howeva, God plans no go work well fo our lives if we no obey hin kommandment. We must to folow wetin he don put down fo us, and we must satisfy him before we fit enjoy hin beta.
Now, every believer must try to satisfy God so that he/she go fit enjoy hin beta grace and goodness to di fullest.
PRAYER
God abeg, help mi so i go stay within your plans so i go dey enjoy your grace and goodness in my life. Help mi to dey satisfy you always, and let mi dey remember all your promise over mi and let dem work fo mi. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
