Dey Humble
Oga Jesus krist talk am di meaning of humility, he talk say "Two men go inside Temple go pray. One na Farisee and di oda one na tax kollector. Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank you sey i nor bi like oda pipu wey dey play wayo, dey sin, pipu wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector. I dey fast two times a week and i dey pay one out of evry ten tins wey i get, give you.’ “But di tax kollector stand fo far place and e nor even look heaven, but kon nak en chest dey sey, ‘God, make you sorry fo mi, bikos i bi sina!’ “I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.” (Luke 18:10-14).
LESSON
True humility no bi by mouth, na by actions! All Kristen must to dey humble so God go dey pleased wit us. We must to dey think of odas as we dey think of oursef, and make we dey treat dem wit respect. Also, make we no judge anyone, but make we make dem know say dem know say dem bi special beings wey God kreate. He dey impotant make Kristen dey ask wetin dey want from God wit respect. Make we no dey pray anyhow,but make we jejely table our request before him, so he go grant dem wetin dem want.
PRAYER
God abeg, kon make mi a humble pesin. Make i dey honor you fo everything wey i dey do, make i dey respect oda pipu also.
Kon help mi so i go make pipu know say dem dey impotant fo dis world. I pray say make you teach mi how to present gospel to all pipu jejely so dem go fit belive in oga Jesus krist and dey saved. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
