God Can And He Go Protect Hin Own Image
Israelites tink say God go komot face from dea sins and protect dem from dea enemis, but dem dey wrong. Despite say dey won bribe God wit mago-mago holiness, he still punished dem! (Israelites go bring God Ark of Convenant to a battlefield wit di hope say God go komfam say he dey wit dem). God refused to defend di disobedient pikin, and dat cause dem to loss di Ark of Convenant wey dey cherish to dea enemis. However, God honored hin name among dose wey collect di Ark of konvenant from di Israelites. He punish dem wit plenti sickness,he kon disgrace dea gods join. Di scripture talk say "Dem take di Kovenant Box go Dagon temple kon put am near Dagon. Wen di pipu fo Ashdod wake-up di next day, Dagon don fall fo groun fo di box front. So dem take Dagon kon put am back fo where e suppose dey. But wen dem wake-up di next day again, Dagon dey groun fo di Kovenant Box front. Dis time, en head and hand don break komot and e laidaun face di door. Na only di body remain. Bikos of dis, til today, nobody fit enter Dagon temple again, bikos anybody wey won enter di temple fo Ashdod, go first mash Dagon head pass". (I Samuel 5:2-5).
To talk am well-well, God also destroy di enemis wey go dey play wit hin glory. Many of dem die premature death.
LESSON
God no bi ordinary pesin,he bi supreme being; and we no fit kompare am wit any dirty. God go do anitin to protect hin image among pipu. The kreator get plenti pawa wey he fit use sofa and kill any pesin we won play wit hin glori. All pipu must do dey fear God and honor him wit respect wey hin sopos get. No one must do anitin wey go provoke God to use hin pawa. Also, evri Kristen must make plenti effort to preach krist gospel so dose wey bi unbelievers go fit dey kanpe wit God.
PRAYER
God abeg, I don learn say he dey dangerous to do anitin wey fit make you angry. Now, i don redi to work witin di scope of mercy. I dey sorry fo tins wey i don do wey no good, and i ask say make you forgive mi.
From now on, i go serve you wit all my heart. I believe in your son oga Jesus krist, and i accept say he bi my personal Lord and savior. Abeg write my name fo di book of life, and make he dey well wit mi fo di days of my life. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
