Oga Jesus’ Business
Peter won know hin stand wit oga Jesus krist since je don leave many tins bekos say he won please him.
Oga Jesus ansa Peter, he say, “I tell una di trut, anybody wey leave en house, wife, brodas, papa, mama or pikin bikos of God Kingdom, God go bless am with wetin pass all di tins wey e leave, both fo dis world and fo di life wey dey kom.” (Luke 18:29-30).
LESSON
Oga Jesus na skilled "Business Man", and he know di best way to rewod hin savants wey dey faithful. Any pesin wey invest into oga Jesus' business no go regret am. Di pesin no go owe debt! Na "Win Win" situesan to serve oga Jesus krist; di adventure dey good, and he get both eartly and heavenly gain. oga Jesus go prospa hin faithful savants on eart and he go take dem go heaven also!
PRAYER
Oga Jesus krist, I understand say your own na rewarding business, and i won dey involved fo am. I don redi to komit myself into your business by konfesin you as my personal Lord and savior, and by say i go serve you faithfully fo di rest of my life. Infact, I don dey work on wetin i talk now: I (Mention your name) konfes you as my personal Lord and savior, and i don repent from my sins. i give you my heart, and i go serve you fo di rest of my life. Amen.
