Forgiveness
Oga Jesus krist tel kristens to dey forgive sins — at any means.
He talk say "If yor broda sin, make you tell am. If e turn from sin kom meet God, den, make you forgi-am. Even if e sin against you seven times fo one day and e kon tel you seven times sey, ‘I don shange’, you must forgi-am.” (Luke 17:3-4).
LESSON
Forgiveness get simple meaning, and he mean say make wey dey forgive pipu wey offend us.
We most to learn from God wey send his son oga Jesus krist make he kon die fo our sins so he go fit forgive us.
God sofa well-well from human fo dea sin and he stil kon send hin son make he kon die fo dem! God. God no dey ask fo anything from us before he dey forgive us.
So, we must to dey forgive pipu wey offend us without say we ask anything. God go bless us if we fit show love to anybodi wey don offend us.
PRAYER
God abeg, kon help mi so i go dey forgive pipu wey don offend me,kon help mi to dey show good heart to dem. I know this go dey hard to do, but i know say your holy spirit go give me di pawa to do anything wey dey necessary.
Abeg kon make me strong, let di devil bi ashamed wen he see mi say i dey show forgiveness to dose wey don offend mi. Na fo oga Jesus krist name i beg all. Amen.
