You Must Fulfill Your kovenant To God
Hannah no get pikin; she prayed and asked God fo pikin, and she promised say she go give any first pikin wey she born to God.
Hannah talk say “My papa, if You go remember mi, your savant, den give mi one boy, I go dedikate am give You as long as e dey fo dis life and dem nor go ever kut en hair". (1 Samuel 1:11). God answer Hannah prayer, and she kon born a boy wey bi Samuel! Di lady honor di promise wey she promise God and she bring Samuel to God. Sha go meet di profet of God, she kon say, “Oga, you remember mi so? Na mi bi di woman wey you si stand fo here dey pray give God. I ask am for pikin and E don give mi wetin i want. Naw, I don gi-am to God. From today go, I dey dedikate am give God.” Den, dem kon woship God fo dea. (1 Samuel 1:26-28).
LESSON
Any pesin wey promise God anything go dey onda oath, and di pesin must to fulfill anything wey hin promise. Jehovah no dey use promise joke; No pikin of God must to dey okay wit hin success and forget to pay anything he promise God. On di oda hand, some pipu dey make special promise to God wen dem dey inside wahala.
Dem go say "God, if you fit help mi in dis situation, i go do so and so fo you". Howeva, dem go forget dea promise once dea preya don answer. God no go dey happy fo dat kain situation: he want make hin pikin dey honor dea promise and dey grateful to him. He fit talk say he go delay future blessing ontil hin pikin honor am. So, all pipu must to dey respect God and dey fulfil dea promises to him.
PRAYER
Oga God, i dey sorry if i don fail to honor my promises to you. I repent today, and i don redi to come back to you. I redeem all my pledges and i go make you hapi wit my offerings. In fact, i go bring special thanksgiving offerings to you and i go dey share di testimony of your goodness fo my life to all pipu. Abeg give mi access to fulfill all my promises,and make i remain your favorite pikin. Na fo oga Jesus krist name i beg all. Amen.
