Selfless Love
Ruth talk say she go stay wit Naomi (her mother in law) afta di her husband die, even say Naomi don old and she no get any good tin wey she fit offer Ruth. Ruth no listen to wetin Naomi tel her, and she talk say she no go go back to her native land. She talk am say “Nor force mi sey make i leave you! Eni wea wey you go, na dea i go-go. Anywhere wey you won stay, na dea i go stay. Your pipu go bi my pipu and your God go bi my God. Wea you fo die,i go die fo dea too and na dea dem go beri mi put. Make God punish mi well-well if i nor do wetin I promise!”. (Ruth 1:14-17).
LESSON
Kristen must to dey show selfless love to oda pipu. No be say we go dey wait fo selfish gain before we fit help dose wey nid our help.
God sef know di best way to rewod good services; he go rewod hin selfless shidren! So,we must try make wey dey serve oda pipu without say dey force us, and make we dey do am jejely, so God go fit bless us.
PRAYER
God abeg, kon give mi pawa so i go fit show selfless love to oda pipu. No let mi dey seek fo my own gain,but allow mi to kea wit heart wey good. I know say you go bless mi on eart if i do wetin you talk, so kon help mi so i go dey do wetin you talk. abeg kon let mi bi pesin wey dey do like you on eart, and say make i qualify to receive your heavenly rewards. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. Amen.
