Feeding On Spiritual Meal
Pipu who benefit from Oga Jesus’ miraku of food provison had simple minds. Dey see Oga Jesus like a magician, and dem go like say make he bekom King so dat he go satisfy dem with plenti magic. Howeva, Oga Jesus correct di yamayama! He talk say, “Make I tell una true word, na bikos of di bread wey una chop naim make una dey find me, nor bi bikos of di mirakles wey una see. Make una nor work fo food wey nor dey last, but fo food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send come.” (John 6:26-27).
LESSON
Food fo belle and belle fo food, but dem go dey destroy togeda! Human effort no suppose dey only fo physical food wey go digest and go dey flush fo di toilet. All pipu must to pursue spiritual food wey go last forever. Oga Jesus Krist na di bread of life wey go last forever, and any pesin we chop di bread no go sofa again. Di savior talk say, “Na mi bi di bread wey dey give life. Pesin wey come meet me nor go hungry lie-lie and di pesin wey belive me, nor go hungry fo wota again.” (John 6:35).
PRAYER
Oga Jesus Krist, I believe say you be di bread of life wey come from Oga God, and I konfes you as my personal Lord and savior. From now, I go dey serve you with all my pawa, and I go folow you to di end Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
