Thanksgiving
King David think about Oga God goodness over hin life; he praise God fo deliverance and viktory ova hin enemies. Di King sing special song to God, he talk say, “…God come down from heaven come hold me. E draw me komot from di wota wey deep well-well. E safe me from my strong enemies and all di pipu wey hate me, bikos dem too strong fo mi. Wen I dey trouble, dem attack me, but God protect mi. Bikos E dey happy with me, E help me wen I dey trouble kon safe me. ” (2 Samuel 22:17-20).
LESSON
Oga God deserve di praise of hin pipu. Na hin dey safe us, and he dey bless pass wetin we suppose get. Di small tin wey we fit do na to dey sing, dance, and praise his holy name. Oga God go bless pipu wey dey praise am, and he go dey pour dem plenti goodness.
PRAYER
Oga God, abeg kon give me heart wey dey appreciate. Let me dey appreciate your grace and goodness fo my life. Let my praises dey okay fo you, so that iI go dey receive more blessing back. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
