Oga God Fit Use Any Pesin
Di skripture talk am some David men wey get strength well-well wey do big tins fo dea lifetime. He dey down say, “Dis na David sojas wey get pawa well-well: Di first one na Josheb-Basshebet wey kom from Tahkemon and naim bi di leader fo, “Di Three”, e fight with eight hundred men and e kill dem fo one war. Di sekond one fo Di Three wey get pawa, na Eleazar wey bi Dodo pikin from Ahohi family. One day, en and David challenge Filistia pipu wey gada fo war, even wen Israel pipu run go back, e stand fight till en hand bigin pain am and en sword kon gum en hand. God give dem viktory dat day. Wen Israel pipu go meet Eleazar after di fight, di only tin wey remain fo dem to do, na to collect all di tins wey Filistia sojas weh die leave. Di third one fo Di Three wey get pawa, na Shammah wey bi Agee pikin wey come from Harar. Wen Filistia pipu gada fo Lehi where dem plant peas put, Israel pipu run from dem, but Shammah nor run and e fight and kill all of dem. God give dem viktory dat day.” (2 Samuel 23:8-12).
LESSON
Oga God dey always do big tins through any pesin wey leave hinsef fo use. God fit use any pesin, and he go use you and me if we koperate wit am! Oga God fit use any pesin pass di way wey we think; if pesin say “Yes Lord”does, Oga God go dey happy, show hin pawa, kon use di felow until di world don dey fill with hin glory! So, every Christian must know this statement wey be say, “If Oga God fit use any pesin, he fit use me!”
PRAYER
Oga Lord, “If you can use anyone, you can use me!” I am ready fo your use. I let down my pride and I release myself fo your use. I no go dey rebellious to you anymore, and I no go do anything you tell me make i no do. I go jump if you say make I jump, I go sit if you say make I sit. I go stop to dey question your authority, but I go kompletely give my self to you. Abeg, use me today, tomorrow, and fo all di days of my life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
