Di Love Of Oga God For Evrione
Pipol wey dey insiad Judah dey kontinue in dia evil work, so Oga God komot hin protesan from dem kin allow dia enemis to win dem. King Nebuchadnezzar of Babylon enta di land of Judah by force kon carry capture hin citizens Di Judeans bekom slave to a gentile king – in a foreign land. Di bible tok am,
“Wen Jehoiakim dey rule, King Nebukadnezzar for Babilon kon attack dem. Jehoiakim obey King Nebukadnezzar for three years, den e kon won fight against am. God kon send Babilon, Siria, Moab and Ammon sojas against am; God send dem go distroy Judah, as E bin warn dem thru en profets. Just as God don tok before, E rijet Judah and en pipol, bikos of all di sins wey Manasseh kommit. Manasseh kill pipol wey nor do anytin and dia blood don stain Jerusalem, so God nor gri forgive dem.” (2 Kings 24: 1-4).
LESSON:
Oga God loves sinas but he ni fit cope wit dia sins. So, he hard for sinas to receive do blessin of Oga God witout say dey repent. Di kreator fit pause evri benefit wey a sina sopos get until he/she repent. On di oda hand, satan fit turn sinful moment to hin own advantage. Di enemi wey wiked fit attack con cause damage to sinas wey no repent. Now, all shidren of Oga God most to dey walk straight wit God. Evrione most to dey please Oga God wit faithful services to receive hin benefits. He dey sure say di kreator go protect and provide for pipol wey recognize hin supremacy kon serve him well-well.
PRAYER:
Oga God, I ask say make you forgive all my sins. Abeg give ke grace to dey serve you wit godly fear. Help me to maintain konsistent relationship wit you, and help me to dey serve you wit purity. Give me pawa thru your spirit to make konsious efot to satisfy yu evri time, so dat he go dey well wit me for all di days of my life. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
