No Rejoice Wen A Biliva Fall
Di skripture talk am di nid of restoresan for bilivas wey fall. He dey written,
“My brodas and sistas, if una si pesin dey sin, make una wey dey spiritual, koll am back. But make una wosh unasef, so dat una nor go fall inside temptashon too. Make una help karry each oda load and if una do like dis, una dey obey Christ.” (Galatians 6:1-2).
LESSON:
God dey hurt and heartbroken weneva a biliva fall away from grace. Di kreator go do anitin wey he nid to do to bring the pesin back. Howeva, Christian most to represent Krist and make serious efot to bring back dose wey don fall from faith. We be Krist ambassador, and we most bring back christian wey don fall.
On di oda hand, Satan fit try to deceive bilivas to change dia focus from bringing back dia fellows. So, Christian most to dey avoid talk wey no necessary of odas. Our efot most be to dey pray, enkourage, and dey involved in oda pipol lives ontil dey don kom back to dia faith. Oga God go use our kompasonate heart as tools to help bilivas wey don fall back to dia feet and gain dia stand wit Oga God. Di kreator go bless bilivas wey make positive kontribuson to di lives of oda pipol.
PRAYER:
Oga Jesus Krist, I ask say make you please make me an instrument of restoresan to christian backslide. Give me pawa to engage dem ontil dey don fully kom back to your love. At di same time, I dey use dis opportunity to pray for evri kristen wey don lost dia first love to dey restored. I ask di Almighty God make he return dem back into true and konfam woship. I pray dat Krist put on his fire on dem so dat dem go kontinue to serve Oga God in spirit and truth. May di Holy Spirit enta my brodas and sistas wey don dey turn dia back from di true love of God! May di power of God rest on all saints to remain kanpe ontil di day wey Krist go show for eart. May brodas and sistas wey dey faithful remain focus to di end, so dat we go fit shout “Hossana” and sings I victory. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
