Di Holy Spirit Na From God
You Must Respect God. Di Holy Spirit show hin big pawa in di lives of di early Christian. He dey reported,
“Dem (Paul, Silas and Timothy) pass thru Frigia and Galatian aria, bikos di Holy Spirit warn dem sey make dem nor prish di message for Asia. Wen dem rish Mysia, dem kon try to enter inside Bitynia, but Jesus Christ Spirit nor allow dem enter, naim dem pass thru Mysia kon face Troas. Paul si dis vishon for nite: One man wey kom from Masidonia stand dey beg am sey, “Make yu kom help us for Masidonia!” Wen Paul si dis vishon finish, wi kon try to go Masidonia. Wi kon bilive sey God don koll us make wi go prish di Good News to di pipol wey dey der” (Acts 16:6-10).
LESSON:
Di Holy Spirit na di sign say God dey in di lives of bilivas. He be di Global Positioning System (GPS) wey leads di shidren of God so dem go dey act rightly. Di presence of di Holy Spirit dey needed by all pipol to have evangelism wey dey effective kon de fruitful for di kindom of God. Also, no one fit serve God faithfully witout di Holy Spirit. So, evri Christian most to pray well-well say make God fill him/ her wit hin Holy Spirit so dat he/she go dey fruitful for kindom of God.
PRAYER:
Oga God, abeg fill me with your Holy Spirit so that I go dey live holy and life wey dey acceptable before you. Let your Holy Spirit give me pawa to dey do evangelism wey dey profitable for your kindom. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
