You nid make you play part so your blessing go quick come.
Joshua tel di Israelites wey dey vex sey land plenti fo dem make dem dey gidigba so dem fit win di canaanites and collect dea lands. God sef don promise dem di land. The bible talk say"Josef shidren kon tell Joshua, “Wetin make you give us only one part fo di land? Wi many well-well, bikos God don bless us.” Joshua ansa dem, “If una many well-well and di kountries fo hill too small fo una, den make una go inside di forest kon klear Periz and Refah land fo unasef.” Josef shidren ansa, “All di kountries for di hill nor good rish for us and Kanaan pipol wey dey stay di valley for Bet-Shean and di towns and Jezrel Valley get shariot wey get pawa well-well. Joshua kon tell Josef family wey bi Efraim and Manasseh sey: “Una get many pipol and betta sojas wey get pawa,una go get pass one share. Di whole kountry for di hill go bi una own; even doh na forest, una fit klear and take am. Una fit distroy Kanaan pipol for der, aldo dem get strong shariot well-well.” (Joshua 17:14-18).
LESSON
Belivas most to ondastand say God blessin no dey come like dat, yu bin nid to wok so hin blessin go cum quick for our lives. Make we say, wen we pray say make God make us plenti, Jehovah fit tok say make hin give us wetin he never finish instead say make hin give us wetin hin don finish. Di tin be say na we go wok so di tin wey hin give us go quick wok. True-true, ani tin wey neva dey redi con leta dey redi to say we do wetin we nid make we do and say make we do our part. we fit tok on few pipol wey God don bless wit some talents, dem still nid make dem wok on am onti dier gift con be sumtin wey pesin go dey look, con turn to full blessin.
PRAYER
God abeg, con give me strength so i go fit put wisdom for my kristen faith, con tell me wetin i sopos do so ya blessin go quick wok for my life, con help me so i go fit wok in faith and do wetin i sopos do so di beta tin wey yu put inside me go quick wok. con give me pawa to wok well-well for my gift and talent so hin go comot well-well for my own joli and for your own glori. Na for oga Jesus Christ name i beg all dis. AMEN
