Show una love to oga God by loving your neigbo
A konfam lawya won make oga Jesus krist no say na him holy pass fo di mata wey bi about to enta oga God kindom. Di man kon ask oga Jesus say, Tisa, wetin i go do to take life wey nor dey end (Luke 10:25),oga Jesus kon tell am"Make you love your Oga God with all your heart, yor soul, your power and mind, den love your neighbour as you love yourself." Jesus kon tell am, “Your ansa korrect, make you do dem and you go get korrect life,but di man won show sey en know well-well, so e kon ask Jesus, “Who bi my neighbour?” Jesus tell am dis story, “One man dey travel from Jerusalem go Jeriko and tif attack am fo road, dem naked am, beat am till e nearly die, den kon waka leave am. Afta, one priest dey pass dea, wen e si di man, e waka pass di oda side fo di road. Na so, one worker fo di temple waka rish wea di man dey, but e waka pass di oda side fo di road. But one Samaria man wey dey travel fo dat road kon rish wea di man dey, as e si di man, e dey sorry fo am. E waka go meet di man kon rob wine and olive oil fo en sore and bandage am. Den e put di man on-top en horse kon karry am go one hotel and e kea fo am dat nite. Di next day, di Samaria man give di hotel manager two silva koins kon tell am, ‘Make you kea fo dis man, wen I kom back, I go pay you any estra money wey you spend.’ Jesus kon ask di man wey e dey follow talk sey, “Among dis three men, wish one you tink sey bi neighbour to di man wey tif attack?” Di man wey sabi di law well-well kon ansa, “Na di one wey kea fo di man, so Jesus kon tell am,make you go do di same tin too." (Luke 10:27-37).
LESSON
Eni pesin who dey tink say he wan enta God kindom must love and live life wey different fo dis eart. Di way we fit show true love fo God bi sey make we love di pipu wey dey our side. Wey bi sey, we no fit say we love God wey we nor see and we nor like pipu wey we dey see. God want make hin pikin dey show love to odas, na evri pesin go see di rewod. pesin wey dey collect am fo di love go dey blessed and hin kon dey close to God which go lead to make plenti pipu enta God kindom. Also, if we dey do wetin oga God talk, we go dey enjoy becos na hin be say we don obey oga God. God sef go show en true love to dose hin pikin who show am by blessing dem. Jehovah go pour hin blessing to di lives of dose who dey obey hin kommandment to dey practice true love. To talk am well-well, oga Jesus talk di stori of di "Good Samaritan" wey hin talk to give di ansa to di lawya wey dey talk say hin dey holy get oga God image wey bi sign if true Kristen wey bi true love (Luke 10:25-37).
Wetin we get from di stori bi say no bi becos we get spiritual title or say we dey religious na hin go make us be a beta Kristen, pesin wey dem go call a beta kristen nid to bi pesin wey dey piti odas, wey don do anitin he fit do to help odas.
PRAYER
God abeg, kon make me kristen wey dey love oda pipu wit heart wey pure, kon help me get heart wey dey piti odas, kon make me pesin wey show am fo wetin you want fo dis eart, make i kon serve you well join am so i go fit get my plenti enjoyment fo your kindom. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. AMEN
