Worthy Of Heaven
Dey persecute Paul fo di role we he play in di gospel expantion, and fo di self discipline wey he get Political leaders like Governor Festus and Governor Felix no do do justice fo corruption reasons. So, Paul kon be victim of wicked judgement. Dem put chain round an so he go face di same challenge of the judicial system wey no dey balance. Di bible talk say, “….Bikos Festus one make di Jew pipu happy, e kon ask Paul, “You ready to go Jerusalem make I judge your case fo dea?” 10 Paul answer, “I stand fo Caesar judgement seat, na here dem go fo judge my case. I nor kommit any offence to Jew pipu and even you yourself know.” (Acts 25: 9-10).
LESSON
Christians dey life with oda pipu in a world wey no dey perfect. Government leaders dey corrupt, and citizens dey sofa. Howeva, christians no go face tough experience fo life. We go get better experience fo di new eart and new heaven wey God go create (Revelation 21:1-5). Wicked people will not share a part in di new heaven and new earth; dea place go be inside hell. He dey impotant say all pipu – wey dey fo government and society – relate with Oga Jesus Krist kon accept Am as Lord, dey important say all people – both in government and society – relate with Jesus Krist and accept am as Lord, so dat dem go fit qualify fo di perfect eart and heaven wey dey come.
PRAYER
Oga God, I truly understand say di way di world wey we dey now don dey korrupt, and new eart and new heaven go soon come. I won partake in dem. Now, I repent from my sins, kon accept your Son Oga Jesus Krist as my Lord. Abeg qualify me fo your kingdom, and help me to dey kanpe with di help of your Holy Spirit. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
