Great Rewod Dey Heaven For Dose Wey Serve
Oga God encouraged Jeremiah sey make he speak out against di nation of Israel bekos say dey turn dea back against an. God give Jeremiah hin backing say hin selection fo such noble task nobi by accident, but he don talk am before di crreation. God talk to Jeremiah say, “Before I put you fo your mama belle, I don know and choose you. I don select you, before dem even born you. Yes! I don choose you as my prophet and you go take my message go everywhere.” So I answer, “My Oga God, I nor sabi talk well and I still young too.” But God sey, “Make you nor sey, ‘I still young.’ But you go-go meet anybody wey I send you go meet kon tell dem everything wey I command you. Di pipu wey I dey send you go meet, make you nor fear dem, bikos I go dey with you and I go safe you. Mi wey bi God, don talk!” (Jeremiah 1:4-8).
LESSON
Na good tin to dey serve God, and di effot get no regret God savants get di backing of dia komanda – Almighty God, and dem go win. Di rewards of pipu wey get special commission fo di service of God no dey only fo dis world, but dem go last forever fo heaven. So, pipu wey take one work or di oda fo God vineyard must dey courageous to do dea best and satisfy God to di fullness, since dea rewards go dey with dem on eart and fo heaven.
PRAYER
Oga God, I receive your grace and boldness to dey continue fo your service. Abeg help me to dey focus, and let me dey serve you di way you want. Let my rewards get value kon dey profitable fo your kingdom. No let my love go in vain; kon count me among di pipu wey go enter your kingdom, and let my rewards dey with dem Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
