We Need To Depend On God
David show am how much he kon dey komfortable after he don put hin trust in God. Di man talk say, “ I don make God number one fo everything wey i dey do and bikos E dey fo my right side, I nor go shake or fear anything. No wonder happiness full my heart, bikos I dey rest well and fear nor dey my life.” (Psalm 16:8-9).
LESSON
Everyone must trust God so that dem go get peace and dea mind go dey one place. All situation go dey under kontrol fo pesin wey trust God. No mountain go dey high and no valley go dey deep fo di pesin. Di creator go take control of everything wey di pesin dey do, so dat he go get testimoni of goodness to share with other pipu. So, everyone must trust God! Trust God in order to get peace and stability of mind. All situation go dey under control fo person weh trust God. mountain weh dey high and valley weh dey very deep no go dey fo di person. The Creator go take control of di person affair, so that hin fit get testimony of goodness to share with other people. So, everyone suppose trust God!
PRAYER
Dear God, if i no trust you who i go trust? Nobody! My goal na to trust you under whatever condition. Now, I pray say make you please give me your grace to trust you. Kon give me pawa through your Holy Spirit to trust and call yu into any situesans of my life, so dat I go prospa. Abeg bless me and let me enjoy yur goodness for all di days of my life. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
