Satan Go Always Confront Believers
Oga Jesus Krist do a miraku wey all pipu (including di critics) no fit komot eyes from. Di messiah form two eyes for a blind man wey ask for help for public. On di oda hand, even say Oga Jesus miraku dey too big to komot eyes, di pharisees summon korage to find an excuse to attack him. Di critics shallenged Oga Jesus say he no sopos any miraku on a sabbath day. Di skripture tolk. Say, “…After e talk finish, E spit fo ground kon take di sand wey E spit put take rub di blind man eye. Then E tell am, Make you go wash your face inside di pond wey dem dey call Siloam (dis name mean ‘Send’).” So di blind man kon go wash en face as Jesus tell am. As e dey come back, e kon bigin see….Dem take di man wey blind before go meet di Farisee pipu, (bikos na fo Sabat Day Jesus spit fo sand take rub di blind man eye). Naim di Farisee pipu ask am again, “How you take bigin see?” E answer dem, “E take di sand wey E spit put rub my eye and after I don wash my face, I kon bigin see.” Some Farisee pipu kon say, “Nor be God send dis man, bikos e nor suppose to do any work fo Sabat Day.” (John 9:6-7; John 9:13-16).
LESSON
Who won please di critics? No be me! Critics no go see any reason to appreciate good works,but dem go look fo excuse so dem go attack pipu wey dey karry out good efforts. Di bitter truth be sey di devil followers go always attack christians. Wetin dem want be say make dem frustrate good efforts, but no child of God must listen to di devil! Instead make we satisfy pipu, we should remain focus to satisfy Oga God no matter wetin happen. Our life-long goal must to preach di gospel and to dey do wetin God want, no mata anything wey happen. However, Oga God keep great rewards fo hin children wey dey gidigba in faith. Jehovah go decorate hin faithful followers with glory and honor, and he go make dea face shine.
PRAYER
Oga good Lord, I don talk say I go dey satisfy you no mata anything wey happen without say I pay di devil and hin followers anything! Abeg give me grace to stay focus and dey please you in everything wey I dey do. No make me allow evil pipu distract me fo my good works. Help me dey carry out di tasks you give me well-well – and make me dey carry dem out as you want am. Abeg prosper me on eart, and fo heaven also. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
